Pastor T.B Joshua don die

by 24USATVJune 6, 2021, 7 a.m. 85
-

Di church confam tori of im death on Sunday morning some days before im birthday for June 12.
According to di post, on Saturday 5th June 2021, Prophet TB Joshua speak during di Emmanuel TV Partners Meeting: "Time for everything - time to come here for prayer and time to return home afta di service.""God don take im servant Prophet TB Joshua home - as e should be by divine will. E spend e last moments on earth in di service of God. Dis na wetin dem born am for, lived for and died for. " Di church tok.
"As Prophet TB Joshua go always tok, "Di greatest way to use life na to spend am on something wey go outlive am".
Prophet TB Joshua leave legacy of service and sacrifice to God Kingdom wey go continue to live on for generations yet unborn."
Di church add say Prophet TB Joshua last words na: "Watch and pray."
Dem also thank di Synagogue, Church Of All Nations and Emmanuel TV Family for dia love, prayers and concern during dis time and request make pipo give di family time of privacy.
Chief Femi Fani-Kayode, wey be former Aviation Minister, and friend friend to T.B Joshua also confam di news of di prophet death afta e bin first say na lie.
"Di passing of my brother TB Joshua sadden me deeply. For around 3.00am dis morning, one of im daughters bin tell me say na fake news and I put for social media to say na lie. Sadly dem mislead me. 5 minutes ago di same pesin call me and confam di say di tori of im death na true and dis news pain me well-well." Fani Kayode tok
E never clear wetin di cause of im death be yet.
Pastor TB Joshua become popular over di years as prophet wey dey perform signs and wonders as many pipo dey come im church for Lagos, Nigeria from far and wide.
Pastor TB Joshua use im platform Emmanuel TV, wey be one of Nigeria biggest Christian broadcast station, both digital and terrestrial to reach millions of Christians across di world.
2021 BBC. De external site no concern BBC.

-

Related Articles

HOT TRENDS

Skid Row Finally Find the Right Frontperson: Lzzy Hale

by 24USATVMarch 28, 2024, midnight2
HOT TRENDS

Former Sen. Joe Lieberman has died at 82

by 24USATVMarch 27, 2024, 11 p.m.2
HOT TRENDS

When the State Is a Serial Killer

by 24USATVMarch 27, 2024, 11 p.m.2